“Sleep… try dey rest”


Sleep, no be the kind wey NEPA take light, force you enter,
but the one wey come when wahala finally agree, come raise hand up like Lagos Agbero.

I dey rest for my papa chest, always.
No be sometimes.
No be only when things dey soft like Agege bread.
Na Always.

When my mind dey run like last bus for CMS,
when tomorrow dey shout my name pass danfo conductor from afar,
I just press my head for Him chest
where heartbeat dey sound like talking drum,
E steady pass river… e no dey rush.

I no dey struggle night again.
I no dey fight darkness.
I leave am for Him hand.
Make Him do security while my soul dey on DND.

Because Him arms long pass my fears.
Muscle wey strong pass my regrets.
Na soft work for am
Only am dey pass all the questions wey life never answer.

For here, faith dey commot for life support.
Hope dey on chilling
And peace,
peace don finally reach house.

So sleep,
You sef, try dey rest for Him bosom.
Always.

UbdaPoet
©2026

Leave a testimony

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.