If you know me before,
You go know sey I no nice
I no even send your papa
Enough to remember your name
As in how nah?
Who you be?
Life nah leave or stay
And I no go beg for anyone
My pride nah my gold
I go rather save am
than to use am trade
E make sense sey my
storehouse full.
If you know me before,
I no kind oh!
Why I go look your face you when you no be my kind
If you no get anything to give me
Wetin you still dey do for my front?
Abeg, comot for road!
If you know me before,
You for know say
As I dey like this now
Somebody don work
overtime for my head
The kind work wey even me
I no fit do for myself.
Nah this work make me
Throway my pride
So I fit restock with something huge – Love
Love nah the only thing
I fit think of now
Anytime I want save something,
Nah only love be my moni.
E don help me get sharp eyes
And e too strong to dey quarrel with am
See ehn, you fit no understand wetin I dey talk now
But I pray say the same person wey do free overtime for my head
Go do overtime for your own head too.
Ere
©2026
