Old Man

If you know me before,
You go know sey I no nice
I no even send your papa
Enough to remember your name
As in how nah?
Who you be?

Life nah leave or stay
And I no go beg for anyone
My pride nah my gold
I go rather save am
than to use am trade
E make sense sey my
storehouse full.

If you know me before,
I no kind oh!
Why I go look your face you when you no be my kind
If you no get anything to give me
Wetin you still dey do for my front?
Abeg, comot for road!

If you know me before,
You for know say
As I dey like this now
Somebody don work
overtime for my head
The kind work wey even me
I no fit do for myself.
Nah this work make me
Throway my pride
So I fit restock with something huge – Love

Love nah the only thing
I fit think of now
Anytime I want save something,
Nah only love be my moni.
E don help me get sharp eyes
And e too strong to dey quarrel with am

See ehn, you fit no understand wetin I dey talk now
But I pray say the same person wey do free overtime for my head
Go do overtime for your own head too.

Ere
©2026

Jesus be REAL!

Pour me a drink He said.

I ain’t got time for y’all Jews she said.

Oops if I were you I’d be asking me for a drink He said.

Now there you go thinking you’re better off than our fathers she said.

Well I got water that  will give them water-well companies a run for their money He said.

Oh really? She exclaimed Well can I get some? She asked.

Go call your boo He said.

What you all up in my business for? I ain’t got none She said.

You are correct cos you’ve had 5 and the one you’re with ain’t yours He said calmly.

What the? You must be prophet! Can I holla at you for a Moment?  We have church at the mountain cathedral but y’all Jews and the like say we all have to get to Jerusalem before we can have church. What’s up with that? She asked.

I’m gonna be real with you, God is done with all them physical locations. These days, any man that wants to worship can do so wherever he is in spirit and in truth.  and that’s what’s up. He said

 

  • Ezeonyeka Godswill (2017)

#TheConversation

#FreestyleFriday