Proof

Your mercy still stand even when life shake me like generator wey no get fuel and when storm raise voice like market women, Your peace calm am, even JBL speakers no loud reach this truth.

I don waka inside fire, yet Your grace na the forth man for that furnace. Blessings wey full my hand, na only your fingerprint fit produce am.

My past be wan dey try drag me back like conductor wey no get change, but the cross sharpaly calm am down. 

As your nails write my freedom na so your blood sign am like court truth. For heaven courtroom, Jesus stand gidigba which living proof reach that one Abeg 

Him love no dey reduce; na so every trial dey shrink like cloth wey see hot water. Even when darkness wan argue, Your light flash am like police for check point, proof wey no dey whine.

When fear dey whisper like thief for backyard, Your Word shout “who goes you!” back.

I dey wake every day because Your covenant cover me like aluminium zinc for rainy roof. And my life? The testimony loud gan, na megaphone wey go always shout: God’s love go always be the final proof.

UbdaPoet
©2025